Your Health and Wellness Partner

"Delayed Speech in a Child: When to be Worried (Pidgin)"

"Delayed Speech in a Child:  When to be Worried (Pidgin)"

Every pikin dey develop for em own pace. This one mean say little difference dey for the rate wen children wen be same age grow. 

Developmental milestones na general guidelines wen child specialists dey use to make sure say your pikin dey progress the way wen e suppose progress . Even though say individual differences dey among children, na which stage delay for speech go become something wen you go begin worry about ?

Wen you suppose begin worry if pikin nor quick talk :

First, you go need find out if speech or language na the problem
Most times dem dey mistake Speech and language disorders for one another. But, you gats observe whether your pikin dey find am difficult to making sounds and form words (speech) or weda na to receive and understand information (language). 

Pikin with speech delay will go form and use words for ways wen go dey difficult to understand. But pikin with language delay go use few words and pronounce them well.
 
If dem miss these milestones by 12 - 18 months:
By your pikin first birthday, their talk go begin to change. Instead of meaningless sounds, dem go begin to imitate the common sounds and words wen dem dey hear around them. Dem go start dey point or wave and dem go fit understand simple requests.

For this point, dem suppose don begin talk some words wen you go recognize like "mama or dada". Dem go even don dey make sentences with these words and go dey copy the flow of normal conversation . You suppose also observe stress for dia speech at this point wen dem dey ask you for something.
 
If dey miss these milestones by age 2:
By this stage your pikin suppose don dey produce words you nor even need to do anything to make am talk . Dem suppose don dey able to follow simple directions and fit imitate speech and actions. 
Your pikin suppose don dey able to tell you em immediate, basic needs and even other information wen nor dey important . 50% of your pikin speech suppose dey easy to understand by people wen dey close to am at this point. 
 
If dem miss these milestones by age 3:
By age 3, your pikin suppose dey able to use about a thousand words and can dem go fit say dia plus even the names of other people around am. Dem go fit ask questions, tell short stories, sing nursery rhymes and simple songs, and create 3-4 word sentences. Three-year olds fit identify simple animals, colors, and shapes.
Pikin for this age fit communicate for simple sentences and phrases e fit nor dey grammatically correct but e go pass the point across. Examples na: "David hungry", "Want water", "We read book?"

You suppose dey able to understand 75% of wetin your pikin dey talk at this point. Strangers suppose dey able to understand at least 50% of wetin your pikin dey talk at this age. If your 3 year old pikin fit understand wetin you dey talk and e fit communicate non-verbally but na only few words e fit talk , e fit get speech delay. 

By age 4, your pikin suppose don dey em way to become radio without battery . 

Conclusion
While these milestones nor dey set for every pikin , your pikin suppose dey able to achieve most of the milestones for this age or a little bit later. If you dey worried say your pikin fit dey experience speech delay, abeg see professional like your family doctor or pediatrician for proper evaluation.