Your Health and Wellness Partner

Diabetes in pregnancy (pidgin)

Diabetes in pregnancy (pidgin)

Diabetes in pregnancy

Diabetes dey common among pregnant women, and na big concern for for dem because of the potential implications to the mother and the unborn baby. 

Diabetes na disorder wen involve how the body take dey regulate sugar. For this condition, na either the body nor dey respond to insulin, the hormone wen dey control blood sugar, or the body nor make enough of the hormone. 

The outcome of two of dem dey the same for both cases: blood sugar go continue to rise to dangerous levels except dem used medicine control am.  


Gestational Diabetes 
This na the presence of high blood sugar while woman get belle. E dey happen wen the pregnant woman nor fit produce enough insulin – a hormone produced by the liver - to regulate sugar levels in the blood. 

This one dey happen for any phase of the pregnancy, but the time wen e common pass na for the second and third trimesters. Gestational diabetes fit cause serious katakata for both mama and pikin if dem nor quick detect am and treat am quick enough.  

Who dey At Risk? 
Gestational diabetes fit happen to any pregnant woman; but you go dey at higher risk if you meet these conditions; 
• Body Mass Index (your weight divided by the square of your height) dey higher than 30 
• If pikin weigh over 4.5kg wen dem born am  
• If you don get gestational diabetes before during another pregnancy
• If your parents get history of diabetes especially for the mama side . 
• If you be African, South Asian, Middle East origin, e nor matter the part of the world wen you they stay . 


SYMPTOMS OF GESTATIONAL DIABETES 
Gestational diabetes fit nor carry any symptoms come or fit match with symptoms of pregnancy, but dem fit detect amduring routine antenatal screening and blood sugar checks. 

If e show symptoms, pregnant woman fit begin to experience any of these.  
• Fatigue or tiredness 
• A dry mouth, causing excessive thirst 
• Excessive urination 
• Constant headaches 
• Difficult to focus on a task 
• Blurry Vision 
• Yeast infections 
Follow your doctor or midwife talk make dem help monitor your blood sugar 

EFFECT OF GESTATIONAL DIABETES FOR YOUR PREGNANCY 
Fortunately, many women wen develop gestational diabetes dey give birth to normal babies bcos of proper management. But, Gestational diabetes dey cause: 

• Pre-mature labor
• Pikin wen go big well well and that one go cause labor to difficult and fit make am be induced labor or come even turn to caesarian session 
• Pre-eclampsia; condition wen dey cause high blood pressure during pregnancy 
• Jaundice wen be the inability of the liver to function well go come make the pikin skin yellow. 
• Loss of pikin due to stillbirth 


TIPS IF YOU GET GESTATION DIABETES 
• Exercise plenty times as your body fit carry you , 3 to 4 times a week na em dey recommended. 
• Monitor blood sugar wella
• Chop plenty of leafy foods, nuts, and fruits 
• Take insulin shots if doctor prescribe am 

MORE TIPS AFTER BABY BIRTH 
secondary concern na say, after you born your pikin, gestational diabetic pregnancy go out you at risk to develop diabetes, later on. Some tips to prevent or delay this deadly disease na ;
• Follow your doctor talk after you born to know more about your health 
• Return to your weight before pregnancy within 6 to 12 months 
• Make sure say exercise na routine so you go fit keep fat commot.  
• Add healthy meal plan out for your diet and cut out too much sugar 
• Before your next belle, make sure say you discuss with your doctor 
• Go for routine health checks to monitor your blood sugar levels