Your Health and Wellness Partner

Hey there! How is your A1C? (Pidgin)

Hey there! How is your A1C? (Pidgin)

How Far! HOW YOUR A1C?
 
You know wetin your blood sugar be? If doctor tell you say you get high blood sugar, but you nor get idea wetin your A1c be, that one need to change.
While e dey important for everybody to know wetin dia baseline blood sugar be by regular testing, the A1c test dey important for people wen get prediabetes or diabetes.
 
WETIN BE A1C TEST AND WETIN E DEY DO ?
This test, wen we also know as haemoglobin A1C (HbA1C), na blood test wen dem dey use to look how your blood sugar be over the past 3 months. E dey give average value of your blood sugar over 3 months, and e dey commonly used to diagnose diabetes and prediabetes.

E also dey used to monitor treatment and how well-controlled your blood sugar dey , bcos high A1C level dey associated with several complications.
The test dey work wen dem measure the amount of sugar wen dey attached to protein for your blood wen dem know as haemoglobin. 
E get normal amount of sugar wen suppose dey attached to haemoglobin; but, this level dey higher for people with too much sugar for dia blood.
 
WHO NEED A1C TEST?
E dey recommended for everybody with diabetes or prediabetes. E also dey recommended for adults who dey 45 years or older, and people with conditions wen put dem at higher risk for diabetes, like people wen dey obese or overweight dem suppose check their A1C levels.
 
WETIN YOU SUPPOSE KNOW BEFORE YOUR AIC TEST?
This test nor require fasting, meaning say e dey okay if you eat before this test. Dem fit do am for any time of the day.
During the test, dem go collect your blood sample . The sample go dey analysed for lab, and dem go tell you wen you go come back for your results.
 
 
HOW TO INTERPRET YOUR A1C RESULT
 
Normal Result Less than 5.7%
Prediabetes 5.7% to 6.4%
Diabetes 6.5% or higher
 
Close monitoring with the help of A1C fit help prevent diabetes-related complications, as e go help your doctor make important decisions wen concern your management.
 
A1C RESULT FIT BE FAKE?
Even tho say this test dey always correct, some factors dey wen fit lead to fake report. Some of them na;
 
• Pregnancy.
• Kidney and liver diseases.
• Severe Anaemia
• Recent blood transfusion.
• A different type of haemoglobin
• Some medications
 
WETIN SUPPOSE BE YOUR A1C GOAL?
If e don dey confirmed say you get diabetes, e dey important to work with your doctor make una set A1C goal for yourself. Even tho say this one fit depend on factors like your age and weda you get any medical condition, the recommended A1C goal for most people with diabetes na 7% or lower.
 
LIKE HOW MANY TIMES YOU NEED DO THE TEST?
People with diabetes suppose do A1C test at least two times a year, and once a year for people with prediabetes.
 
If you get prediabetes, you dey at higher risk to develop diabetes and heart diseases. Them don follow people with prediabetes talk , dem tell dem the kind food and lifestyle changes wen fit prevent am to turn to full diabetes.
 
SUMMARY
A1C test dey serve many purposes: dem dey use am diagnose prediabetes, diagnose diabetes, and monitor treatment for diabetic patients. If you get prediabetes, diabetes, or any of the risk factors wen we don talk about , follow your healthcare provider talk about this test so you go know your A1C!