Your Health and Wellness Partner

"How to identify and avoid fake drugs (Pidgin)"

"How to identify and avoid fake drugs  (Pidgin)"

How to identify and avoid fake drugs 

Many common prescription medications for market get fake versions and sometimes dem dey cheap pass original ones and dem dey less effective, plus dem get greater health risks. 
Na everyday dem dey produce all dis counterfeit drugs and distribute am to buyers wen nor even suspect anything at d risk of dia health. For here, we go describe wetin counterfeit drugs be and how to avoid dem .     
Wetin be Counterfeit Drugs? 

Counterfeit drugs na medicines wen dey produced to look exactly like actual branded or generic drugs but dem nor get the correct constitution of the real drug. 
For many cases, the counterfeit drug nor go even contain any of the constituents of the real drug.     
D pipo wen dey manufacture all dese drugs fit even create the exact packaging of the actual drug to deceive buyers. 

But, dese medicines nor dey produced by the manufacturers of the genuine versions..    
The problem with fake drugs be say nor be only say e nor dey effective but also problem dey with dia chemical compositions. Many of dese fake drugs get inactive constituents, like chalk, wen fit dey harmful to the body. Dese chemicals fit cause health problems like allergies, organ failure, or even death.    

So Therefore, the health problems of fake drugs na two and dem include; 
1) problems wen go result from the ineffectiveness of these medicines to treat the ongoing condition.
2) problems wen go result from the direct effects of the medicines.     

Now wen you don dey aware of the dangers wen dey follow counterfeit medicine waka come ,you need know how to take recognize and avoid them.    


How to Avoid Fake Drugs    
Even tho say manufacturers of fake drugs dey produce dem to look just like the real ones, e get somethings wen dey give dem away. Some proven ways to take avoid say you buy counterfeit medicine:    

Know your Drug    
You know how genuine medication suppose look like? This na the first step to take avoid counterfeit medication - Visual inspection.   
When you collect your medication, pay attention to the physical details - the way the drug appear , the packaging, and the instructions about em usage. Things to look out for when you dey inspect drug.     

• Examine the package and check weda any defects dey for d way em appear: the letters difficult to read? the prints flat instead make e dey raised? the expiry dates dey miss? the batch number dey miss? The spelling nor correct ? the manufacturer’s address and contact details dey miss? the manufacturer’s license and registration numbers dey miss?     
If you get positive response to all dese questions don you don get clue say the medication fit be fake.    

• Check for the security seal of the package: Drugs wen be say d package seal don break or dem don tamper with am dey more likely to be fake .   
• Check for the drug’s registration number: drug with no registration number of the appropriate drug agency like NAFDAC number for drugs wen dem dey sell for Nigeria and the drug listing number or  National drug code for drugs for United States) dey likely to be fake.    
Also, if this number dey present but dem not print am clearly e fit be fake.     
• Check the appearance of the drug: Nor overlook unusual crystals for the body of the containing bottle or the tablet. Fit be sign say the medication na fake. Also, if the drug look like say e dey crushed or broken, e fit be fake.     
Nor be only that one o , if you notice any abnormal discoloration for the tablet, dis one fit also suggest foul play. Fake medications also get abnormal softening, hardening, or swelling.    
Price: The price fit also be sign say dat drug na fake. If you come across unusually cheap brand of medication wen you dey use, the brand may be fake. Even tho say some fake drugs fit cost reach or even cost pass the genuine ones.      
Buy from a Reputable Pharmacy    

Chances dey slim say pharmacy wen dey better name to protect go give you counterfeit drug. Avoid to dey buy your medications from unregistered drug stores or open markets. The chances of say you go buy fake drug dey very high from dese dealers. This na because these sources dey unregulated and unsupervised, so therefore, dem fit easily partake for the fake drug business.     
Online pharmacy stores nor dey exempted . Make sure say you order drugs from approved online pharmacies. Approved online pharmacy sites dey carry standard seals, like the Verified Internet Pharmacy Practice Sites (VIPPS) for online drug stores in the United States.    

Report any Suspicious Drugs    

If your drug taste differently from how e been dey taste or if you develop unusual side effects like allergic reactions, the drug fit be fake. If you get dese concerns, stop to use the drug, report to your healthcare provider and contact your local drug control agency.  
Drugs dey designed to help us fight off illnesses and diseases but with fake drugs wen dey enter the market, e fit dey difficult for people to get rid of d diseases. With the recommendations for this article, you nor go only increase d chances of say you buy standard, high-quality drugs, but you go also reduce or even remove d chances of say you use fake medications. This one go keep you safe and healthy everytime.