Your Health and Wellness Partner

"Should you exercise during pregnancy? (Pidgin)"

"Should you exercise during  pregnancy? (Pidgin)"


Grace don dey prepare for her second pikin like this . She get belle and she look sharp for hospital ward. Doctor see am come ask how she dey . She tell am say she fine and she dey ready to push .  

After midwife examine her , Grace come see one of her old friend for the bed wen dey next to her own . Dem don admit her three days ago with full-term pregnancy, but dem dey wait make her labor start . 


Na so her friend say , Grace see as You look strong , but I nor understand why i never start to contract”,. Grace come ask her how often she exercise?”.  
She say she nor ever exercise . Grace surprise she come tell her how she form habit of regular exercise and na Wetin  
help her to stay strong”. The midwife say her cervix dey dilate well and na thanks to her active lifestyle. 


Regular exercise during pregnancy na healthy habit wen many pregnant women dey fail to adopt. And if you be fitfam e go dey satisfying to know wetin your active lifestyle get in store for you as your belle begin big. 
E dey normal to hear phrases and advice say you must “eat for two”, but say we nor dey hear the “exercising for two” advise nor mean say e dey less important. In fact, you need regular exercise during pregnancy, but not be say you go come over do am . 

Beforeyou start , read up, and find out which exercise your body need, and the benefits wen dey wait you. 

Workouts during pregnancy 

Walking: Put am for mind say you nor need exercises wen go stress you but simple walk around your yard, street, at the park, and your neighborhood. 


• Running on the treadmill : Running na strenuous exercise, but when e dey regulated on treadmill, you fit run safely without any threat to you and your pikin. This one sef you and your husband fit do am together , so in addition to your body and baby, you fit enjoy some bonding time with your partner and that one dey necessary. 


• Dancing. As your body begin to change, the hormones wen dey follow pregnancy go dey upset your emotions sometimes, but regular dance aerobics na all you need to stay happy. If your partner nor like to dance, find one pregnant friend and make una plan dance timeout together if you nor fit afford dance class. You go enjoy the improved mood wen go come at the end of every dance session. 

• Yoga. This one dey always come handy with a lot of benefits. If you be yoga lover, your quiet moment dey important to help you release the stress load and to get you vibrant again. All you need to do na get the right and recommended poses from your instructor. 


• Swimming. Pregnancy dey come with the hot flushes, the heat get as e be and you go dey wish say you fit stay the whole day under friendly temperature. Well, swimming fit dey beneficial, but you must know how to swim before you begin wear swimwear and swim. 

The WHO don recommend say healthy lifestyle suppose include aerobics and strength-conditioning exercises wen go give level of fitness during pregnancy.  
The benefits of these exercises plenty so you nor suppose hesitate to start to live active life even with the pregnancy. 


The Benefits Of Exercises During Pregnancy. 

E dey enhance mood. hormonal change fit turn your mood against you and everyone around you. When this one happen , dancing habits go help you sweat and smile at your efforts, and this one na the lift your mood and baby needs. 

• E dey relieve backache. thanks to your abdomen web dey big come outside, weight gain, and posture changes, your back go begin ache and e go bring plenty discomforts. While the frequent taking of pain killers nor dey advised, you fit create the relief you need through simple exercises wen your doctor recommend. Exercise like “sitting on the wall” and other posture exercises dey advised here. 

• Better sleep. Sleeplessness na one of the issues wen dey associated with pregnancy because person go wake up to piss , and backache sef go dey , heartburn, and other discomforts wen go make your not fit sleep for night . But after evening stroll wen make you tire your body go naturally crave for the comfort of your bed. And when you rest well, your pikin for belle go dey equally happy too. 

• E dey hasten labor. Prolonged labor nor be anything wen any woman desire even when medical solutions fit help to hasten labor. Natural progressive labor na the one wen dey preferred and that one dey come in handy with active lifestyle during pregnancy. 

• Weight management. weight gain dey follow pregnancy waka come most times , but you fit prevent unhealthy weight gain with regular aerobics. This one fit reduce the risk of gestational diabetes, one form of diabetes wen we dey see for some pregnant women. E fit also make am easier to return to pre-pregnancy weight after delivery. 

Some take-home tips 
• Stop to walk or swim when you dey feel tired or dizzy. Remember, everything must dey moderate for you to get your desired result .  
• If you dey visit the gym, choose class wen dey designed for pregnant women. 
• Your sports wears must dey comfortable, skip the tight and non-stretchy ones. 
• Stay well hydrated while you dey do aerobics 
• Get partner wen go keep you motivated. 

Pregnancy nor be license for inactive lifestyle, in as much as you need to dey cautious with everything you do. Living the “fit life” dey always recommended at any stage of life. And as a pregnant woman, you dey free to stick to your aerobics, stay healthy and birth healthy baby.