Your Health and Wellness Partner

"What to know about prostate cancer (Pidgin)"

"What to know about prostate cancer  (Pidgin)"

Prostate cancer 

Prostate cancer na one of the commonest cancers for men, and potentially life-threatening cancer Wetin fit spread to other parts of the body and e dey cause severe symptoms. 
Many questions and concerns dey about prostate cancer; so for here, we go help una with essential information wen una need to know about am. 


Prostate cancer dey affect one part of the male genital organ and na prostate gland be the name em primary function na to produce fluid wen dey nourish sperm cells. 
As men dey old, the prostate gland go enlarge and e fit dey affected by unregulated enlargement wen dem call cancer. But Prostate cancer, nor be ordinary enlargement; e dey represent unique uncoordinated growth of cells of the prostate wen go begin to spread to other organs, including the spine, lungs, and kidneys.   


How to know say you get prostate cancer?   

One of the first signs you fit experience with prostate cancer na say you go find am difficult to pass out urine. This na because the pipe wen piss dey pass for the penis pass through the body of the prostate gland. So, as the gland dey enlarge, e dey squeeze the pipe, dat one go make am difficult for you to pass urine. Other common symptoms of prostate cancer na:    

• Urine leaks   
• Inadequate emptying  of urine   
• Frequent urination at night   
• Difficulty urination   
• Strong urge to urinate   
• Painful urination   
• Urine breaks—instead of a steady stream   
• Blood in urine   
• Blood in semen   
• Weak erection — especially of sudden nature   
• Weight loss without trying   
• Bone pain   

If you get any one or two of these symptoms e nor necessarily mean say you get prostate cancer. When you man reach certain age, the diagnosis go dey more likely; but e go still need to visit healthcare provider for thorough clinical evaluation.    


Wetin dey cause Prostate Cancer?   
Like many other cancers, change for the DNA of the prostate cells fit lead to cancer, but the actual cause nor dey known; but, some risk factors wen don dey linked to am na :   

• Age: as age dey increase person risk of prostate cancer sef dey increase. 

• Race: prostate cancer dey common among people of African descent   

• Family history: if member of your family suffer from prostate cancer, e go increase the chances if say you go get am too . 

• Obesity: Obesity and overweight dey increase chances of say person suffer from many forms of cancer   

How to prevent prostate cancer?   

• Eat healthy- you nor fit go wrong if you eat plenty fruit and vegetables.   

• Exercise— if you dey exercise some days of the week e go keep you healthy and safe from cancers and other diseases   

• Watch your weight—maintain healthy weight cos e go help to prevent prostate cancer and other forms of cancer.   

• Routine screening test: To take periodic PSA (prostate-specific antigen) test e dey good especially for older men. You fit also undergo DRE (digital rectal examination) , where your doctor go put two of em fingers wen e wear glove put inside your rectum to feel for and examine your prostate gland for any abnormal features. Check your local guideline to see the age you suppose start prostate cancer screening and how frequently you suppose dey do am    

Conclusion   
Prostate cancer na one of the commonest diseases wen dey affect men. While e dey cause noticeable symptoms like blood for urine, painful urination, and frequent urination; e fit nor show face with any symptoms at all. If you notice symptoms wen suggest say you get prostate cancer, please seek medical attention as soon as possible.