Your Health and Wellness Partner

"What you should know about Lassa Fever (Pidgin)"

"What you should know about  Lassa Fever (Pidgin)"

Wetin be Lassa Fever ? 

Na Lassa virus dey cause Lassa fever. 
And na African rat dey spread the virus, you fit see this rat for sub-Saharan African countries like Nigeria, Guinea, Benin, Sierra Leone, and Liberia.

How Lassa fever dey take spread?
Na African rat be the tank for Lassa virus. This one mean say this rat fit get Lassa Fever make he no sick or die. Instead the rat wey get the disease go dey piss or shit the virus for long time and sometimes him whole life. 

Person fit come carry the Lassa fever if the piss or the shit of the rat touch food or water wey the person chop. How the infection take dey spread from person to person na when person wey nor get am come go touch the shit, piss and blood of person wey don already get am. 

This movement from one person to another person dey common for clinic areas like hospitals, clinics and laboratories, na wetin make people wey dey work for clinic dey at risk to get the disease easily.

Wetin be the sign say you get Lassa Fever?

Lassa Fever get plenty plenty signs. The signs dey from small to serious signs like hot body, headaches, all body pain, weakness, chest or belle pain, vomiting and watery shit na dem dey for the small small symptoms. When e come serious patapata person go come fit dey bleed from em gums, nose, eyes, even kidney failure and brain wahala wey fit cause deafness. 
These serious signs Dey happen to about 20% of people wey get Lassa Fever, wey dey lead to their death or for-life problems.

Because say, the signs of Lassa Fever no dey specific e dey make am hard to easily detect am for hospitals. 

But for places where Lassa fever dey common, high index of suspicion go dey in place among health workers, and people with this disease go dey promptly identified and treated. 
E dey estimated say 1 in 5 people with Lassa fever dey die from the disease or em complications, and these figures dey set to rise well well during some outbreaks.


How I fit take prevent Lassa fever?

To prevent Lassa fever go start with make you understand the way the disease take dey spread from rats to human being and how e take dey spread among humans. The focus of prevention na to reduce exposure to the virus and the way to run am na to avoid contact with the rat wen dey spread am plus avoid their piss and shit join. 

Good hygiene practices like make you dey wash hand, removing dirty from the environment, etc. all of dem don 
show say dem dey reduce the way Lassa fever take dey common . 
Begin dey keep food for rat-proof containers to prevent contamination with dia piss and shit.

Avoiding contact with person wen you suspect say e get Lassa fever during outbreak all this ones go reduce the spread of the Lassa virus. As e be like this no vaccine dey currently for Lassa fever. People wen sick make dem go hospital. Healthcare workers dey advised to use the appropriate infection control measures wen dem dey care for anybody wen dem suspect or confirm say e get Lassa fever.