Your Health and Wellness Partner

"Why do I have blood in my urine? (Pidgin)"

"Why do I have blood in my urine? (Pidgin)"

Why I see blood for my piss   


If anybody see blood for dia piss heart go cut dem and e go raise suspicion of serious health problems.   
Blood for piss dey described in two ways: microscopic, na only under microscope you go fit see the blood, or gross, you go see the blood inside the piss.   


Blood for piss dey caused by some medical conditions, from mild to severe, and each episode need evaluation by doctor.    

Wetin dey cause blood for piss ?   
Normally, blood nor dey leak into piss. Some of the conditions wen fit make am happen include:    

•Urinary tract infections: Urinary tract infections (UTIs) dey happen wen bug enter the urinary tract. UTIs dey cause pain wen person dey piss , frequent urge to piss, and strong-smelling urine. The infection fit affect the bladder, the kidneys, or two of dem .   

•Large Prostate: The prostate dey under the bladder for men. For some conditions, including prostate cancer and benign prostatic hypertrophy (BPH), the prostate go enlarge and fit go damage adjacent blood vessels, na em go come cause blood to leak go the urine.    

•Kidney Disease: Some diseases wen dey affect the whole body fit affect the kidney and go cause blood to leak go the urine. Na many types of kidney diseases wen fit also cause bleeding na em dey . Examples na cancer and kidney inflammation called nephritis.    

•Kidney Stones: Kidney stones na product of crystals wen form for the walls of the kidneys or bladder. These crystals fit build up to block the flow of piss from the kidneys and damage blood vessels wen dey along the urinary tract. Other symptoms of kidney stones na loin pain wen fit dey serious or mild.    

•Medications: If you dey use blood-thinning medicines, you fit get bleeding for your urine if the medicine allow your blood make e too thin.  

How dem dey treat bloody urine?    

The treatment for bloody urine go depend on the cause. Your doctor go order some laboratory investigations to identify wetin fit dey cause the symptom. Common investigations wen dey needed to evaluate bloody urine include:   

Complete blood count   
Urine analysis   
Urine culture test to look for bugs   

For men wen don old pass 40, your doctor go examine the prostate with one gloved finger wen dem go pass through the anus to evaluate the size and texture of the prostate.   
Your doctor fit also order PSA blood test to screen for prostate cancer. Dem fit also use Imaging investigations like ultrasound or CT scan to examine the kidneys, bladder, and other internal organs    

Treatment go depend on wetin dem identify as the cause. Treatment fit include:    
• Antibiotics if na kidney infection or if UTI dey diagnosed   
• Medicines to shrink the prostate or surgery to remove part or the entire prostate for some situations.    
• Treatment or surgical removal of kidney stones    


Bloody urine go make anybody panic . While e fit nor always dey caused by dangerous disease, e worth make you see your doctor for proper evaluation and treatment.